+ Reply + New Job/Topic
Results 1 to 8 of 8

Topic: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

  1. #1
    Newbie Maximus Madiba's Avatar
    Join Date
    Jan 2009
    Posts
    24

    JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    The other day l been enter NAIJAHOTJOBS BRT BUS from palmgrove de go my Office for VI...l for use my personal ride if no be say i no wan come tanda for holdup...the woman wey sidon for my side carry pikin...her name na florafab...na im the pikin come dey cry heavily like say im mama de chook am needle...main, the noise was unbearable...to cajole the kid, na im d woman put her hand inside her handbag begin tell her say ... sammie77 oya stop crying, l ll give u this kpof-kpof if u stop crying...for where, instead the pikin increased the cry...d woman come say ...l go carry the kpof-kpof throw give this broda wey sidon for our back ooh(funny enough as l look back na dawaskee i see)...na im d woman throw her hand go back come tell d pikin say...ntoo ooh i don give d kpof-kpof to broda as u no wan stop crying...the kid kept crying...this time the woman entreated the kid to take the Bole wey dey inside her empty clutched hand n stop crying otherwise she will give it to the broda behind...no way n d woman still flung her hands back a if she threw it to dawaskee...finally, the wan wey come cause commotion inside bus na when the woman tell the pikin say ...oya sammie stop crying and l will give u breast to suck...or u wan make l carry give this broda for back...pikin no even gree look the breast...i know say for smmie mind im go de talk say..which kind doti breast every day..u think say na milk i de get from inside am...na so so water waterfull am...i for kukuma take purewater...at least that wan go de chilled...but u know now...pikin no fit express imself openly...u go say how i take know...na d eye wey an elder dey take know wetin de inside bag...ok, lets continue our tori...na im d woman fling her hand again go back...as u no wan take the breast l don give am d broda for back too....NA IM DAWASKEE( D BRODA WEY SIDON BEHIND FLORA TAKE HIGHVOLTAGE ANNOYANCE STAND UP)...MDM SEE MAKE L TELL U...U SAY U GO GIVE ME KPOF-KPOF...U NO GIVE ...U SAY U GO GIVE ME BOLE I NO COME SEE AM...SOTEE I DON SIDON HER PASS MY BUSTOP tee tee...U COME FINALLY SAY U GO GIVE ME BREAST N U NO GIVE ME...U SEE 2DAY 2DAY, U MUST TO GIVE ME THAT BREAST TO SUCK...I NO BE DAT UR SMALL PIKIN WEY U GO FIT DECEIVE EASILY...NA U CARRY UR GODLY MIND WAN GIVE ME D BREAST...ABI I ASK U...I MUST SUCK THAT BREAST 2DAY...I DE SERIOUS OOH!

    no be small thing my ppl...u needed to be inside the naijahotjobs BRT bus that dat day to see what transpired...it took 5 abledodied guys...kemistkris, dagunro,felixodeli,coolguy and ineedtopass to holddown dawaskee so that florafab can escape from the bus with her baby(sammie)...thank God for the driver that day..Oga DVT..he had to give dawaskee an extra ticket to get back to his bustop...for him to cool down...i even still dey blame oga DVT cos he was loudly playing that song wey de talk say..."l see ejiro for cover, whem im de press ur mighimighiwanawan..."...that song must have triggered dawaskees fuming....the argument that ensured was more interesting that the saga...na im ppl come de talk for bus say maybe d man wsnt priviledged to suck breast when he was small..some even say, u know seem im dracula teeth, maybe im wife no de gree am suck d thing as that in teeth dey possibly always wound her tits...some say for where, who dash monkey banana, dis one fit to get wife?...no be small thing ooh...d wan wey touch me well well na when wan woman wey carry pikin too...her name na jeanie...come talk say...MY PPL MAKE UNA NO MIND MEN...UNA NO SEE AS MY PIKIN DE CRY HERE...D PIKIN DON TIRE TO DE SUCK ONLY FEEDING BOTTLE SINCE THEY BORN AM...NO BE SAY I NO WAN GIVE AM BREAST OOH...ONLY SAY EVEN ONE DROP NO REMAIN INSIDE...THE PAPA NO DE GREE THE THING REMAIN AS IF IM NO DRINK WHEN IM DE SMALL...U SEE MEN , E NO DE DOO THEM...DE GO DRINK THEIR MAMA OWN WHEN DE DE SMALL...E NO DO THEM....DE GO STILL DRINK DIA GIRLFRIENDS OWN, E NO DO THEM...DE GO STILL DRINK THEIR WIFE OWN E NO DO THEM...THEN TELL ME THE ONE WEY GO DO THEM...
    NA THERE L COME REALIZE WETIN HAPPEN TO DAWASKEE WHEN IM SMALL...shame no gree me stay again inside bus...l had to alight at the next bustop...bcos i no beliv ay some of our men fit do that kind thing...any way, thats is life for u....no be 2day l see one man from austria, for CNN, wey follow im daughter born 7 chilren by force de cover him face for court...d man say im de shame ...after over 24years


    I PERSONALLY DEDICATE THIS JOKE TO MY BEST FRIEND ON THE FORUM...mdm florafab...LET ME TICKLE HER FANCY A BIT..I KNOW FOR SURE THIS IS HER KIND OF JOKE!

    pls all the names are fictitious and apologies are hereby given for any coincidence!

  2. #2
    Senior Member SOME-MORE's Avatar
    Join Date
    Aug 2008
    Posts
    271

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    @Maximus Madiba abi wetin u dey call urself...in as much as this forum avails us d oppurtunity to express ourself, i believe that decency and respect should not be sacrificed in d process!.....it will amount to self deciet on my part if i claim that i did not enjoy this ur second hand joke..... but the truth remains that u were a bit vulgar and disrespectful to Sammie, Florafab, Jeanie and co ....who are our esteemed senior colleagues in dis house!
    without reservations i strongly submit that u tender an unreserved appology to them forthwit!
    ....dat is if indeed u sucked ur mamas Nunu as much as i believe dat u did!....bcos 4rm all indication it appears dat u are a breast addict!............ O
    NE LUV!
    be good all the time

  3. #3
    Senior Member Owlu's Avatar
    Join Date
    Jan 2009
    Posts
    107

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    I no like this joke at all. Maximus madiba should have thought of another joke.
    Unbelievable! I see birds in the ocean and fishes flying.

  4. #4
    Newbie ayb7's Avatar
    Join Date
    Jul 2008
    Posts
    12

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    Total display of joblessness

  5. #5
    Newbie Maximus Madiba's Avatar
    Join Date
    Jan 2009
    Posts
    24

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    Quote Originally Posted by ayb7
    Total display of joblessness
    I am gainfully employed and can even employ u gainfully too, if l deem u competent...l was only trying to satirize the kind of joke that trips nigerians...d l go die and co type of jokes...halfbaked and full of vulgar stuffs...well am yet to see a nigerian comedian that will trip a gathering of maybe foreign professionals like say in US, BRITAIN etc...speaking straight, correct and connective english all through...worldclass...like some of the south african guys l see on channel O...as a matter of fact this joke was culled from a very popular nigerian comedian...l just added some orishirishi to it....

    @some more....often times its wise to wait and think b4 responding to foolishness...sometimes silence is the best answer...am yet to find time n classify u...u wan weep pass d bereaved ppl abi...ll talk to u later

  6. #6
    Newbie Maximus Madiba's Avatar
    Join Date
    Jan 2009
    Posts
    24

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    Quote Originally Posted by SOME-MORE
    @Maximus Madiba abi wetin u dey call urself...in as much as this forum avails us d oppurtunity to express ourself, i believe that decency and respect should not be sacrificed in d process!.....it will amount to self deciet on my part if i claim that i did not enjoy this ur second hand joke..... but the truth remains that u were a bit vulgar and disrespectful to Sammie, Florafab, Jeanie and co ....who are our esteemed senior colleagues in dis house!
    without reservations i strongly submit that u tender an unreserved appology to them forthwit!
    ....dat is if indeed u sucked ur mamas Nunu as much as i believe dat u did!....bcos 4rm all indication it appears dat u are a breast addict!............ O
    NE LUV!
    "....it will amount to self deciet on my part if i claim that i did not enjoy this ur second hand joke..."

    @Some-more/0liver Twist words fail me lot regarding how to describe and classify the kind of malady that you seem to be suffering from...just analyse the comment in quote...u seem to talk b4 u think and even mean another thing when actually u said something else...the kind of humans l fix as hyperpolycompex...u will make a good sample of a Nigerian that needs to be rebranded...u wouldnt bat an eyelid in taking three sides or more over an issue thats just two sided...come to think of it, u want to cry more than the bereaved or what...which college of education did u graduate from or was that a typographical error too...

    mind u l correct satirically...l mean no insults...l love you!

  7. #7
    Senior Member jeanie's Avatar
    Join Date
    Aug 2008
    Posts
    315

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    , @some -more,my broda, please i beg u do not mind this guy, i know that madam flora is somewhere coining what to tell him, so please do not waste ur saliva.it is ok
    JEHOVAH JIREH IS GOOD TO ME

  8. #8
    Newbie ekibell's Avatar
    Join Date
    Sep 2008
    Posts
    10

    Re: JOKE DEDICATED TO MDM F******B!

    pls dnt crucify him. he was only trying to be funny but unfortunately ...

+ Reply

Similar Topics

  1. IF LADIES WERE BANKS,.... (Enjoy the Joke)
    By noto in forum Open Discussions
    Replies: 0
    Last Post: Sep 11th, 08, 12:09 am
  2. God IS WITH US (JOKES)
    By sixteen in forum Open Discussions
    Replies: 10
    Last Post: Mar 24th, 08, 07:32 am
  3. Replies: 0
    Last Post: Feb 29th, 08, 02:43 pm
  4. Ladies Pls Be Careful..... (JOKES)
    By sixteen in forum Open Discussions
    Replies: 1
    Last Post: Dec 21st, 07, 02:09 pm
  5. HOSTAGES (JOKES)
    By sixteen in forum Open Discussions
    Replies: 9
    Last Post: Oct 2nd, 07, 03:57 pm

Posting Permissions

  • You may not post new threads
  • You may not post replies
  • You may not post attachments
  • You may not edit your posts
  •