After twenty something years for inside Prison those RAGAMUFFINS kon release Mandela to freedom. This na after some years wey countries around the world don hala ‘free Mandela’ O! Mandela gained his freedom and became President of Republic of South Africa (RSA)

Mandela kon think am sey e go dey proper make him make some tour go thank some of those countries wey dey for the forefront of ‘free Mandela’ chorus.

Na Planet Africa be him first stop, then Europe, then the Americas. Na Naija dey last of the itinerary no bi for any particular reason O! Na so dem just plan the journey.

So every Africa country wey Mandela go na so the President of dat country go dash am something wey dey unique to dat country like, Tea, Coffee, Cocoa, Oranges etc.

Make u wait for am now!!!!!

Dat time wey countries dey hala for ‘free Mandela’ Naija get different ruler, when Mandela came calling na ABACHA dey. Now, ‘Abacha’ for one Naija language mean ‘something wey no good’. And some people wey know di man well-well wen him bi ‘Commanding Officer’ for Ibadan sey dem sure sey na under him foot na him e bi like say him brain dey.

It was time for Mr Mandela to take his leave of Obodo Naija, Abacha kon greet am say him too wan give am present wey dey unique to Naija, he just enter one small room count $5 million. Y-e-e-e-s, Five million American Dollars commanded Major Mustafa make dat one kaya di thing go give Mandela for di sitting room wey dat one still dey sit-down.

Mr Mandela open the bag kon see green back Dollars. Now, Mr Mandela don dey inside prison for sometime and age don dey catch up with am. Na him Mandela turn to his entourage kon say why dem no tell am say dem don reach America and also dat America don get black President, this was long years before OBAMA O!

Mr Mandela’s entourage told him they are still in Africa, West-Africa and Nigeria to be precise. A country endowed with Oil generating petrol-dollars but not blessed with good leadership and that this gift is a typical example of wastage endemic in the country.

Mr Mandela told his pilot not to hurry to climb di sky O! bicos him won take a tour of Naija from the sky make the plane fly low so dat him go see for himself. Mandela kon see street full of beggars, abandoned projects, pot-hole filled roads, dilapidated hospitals. Na dis tour dem still dey do when night kon fall. One by one each part of the country dey fall into darkness as NEPA do their show, Mandela turn to the person next to him and sey ‘this is one unique country so when people go to bed everybody synchronises their action and switch their lights off’? Noooo! Answered one Naija journalist wey dey travel with Mandela – NEPA don know sey Naija people don hold Phd for ‘suffering and smiling’ so dem go kill our lights for night make we sleep inside darkness and sweat – dem go give lights to Upper Volta abi na Niger Republic for night!!!!!

Na for how Mandela kon make his millions now?

Mandela after touring Naija see all the poverties in the midst of petrol-dollars wey dey flow kon vow sey him no go join African Leaders wey dey dip all their 20 fingers inside public pot O! Quic-quick him don call him secretary say make dem add ‘GUEST SPEAKING’ to the itinerary. When dem reach Europe and the Americas people kon dey pay to come listen to Mandela speaking about his Prison years!
My BRODA na from Naija Mandela device alternative means of making money instead for steal from public purse O!!!

So na why the soldier boys wey don rule us no leave our money take develop the country and lay down the infrastructures for the present and future generations make dem kon go open something like ‘BABANGIDA SCHOOL OF INFANTRY BRIGADE’ to make money, instead for rob Naija blind

NA FOR WHICH DAY WE GO WAKE-UP FOR THIS COUNTRY SELF!!!!!