+ Reply + New Job/Topic
Results 1 to 2 of 2

Topic: Jobseekers and N.I.T.T

  1. #1
    Newbie SOCCWIZ's Avatar
    Join Date
    May 2009
    Posts
    3

    Jobseekers and N.I.T.T

    Weda you dey look for job O! abi you bi gainfully employed O! You dey for Naija O! abi you dey abroad, we are all affected one way or the other by 'Nigerian Intentional Theif-Theif.' Because na for my country a no say when people dey aspire to become politician na to go there go serve their pockets and not the people.

    Na for dis site a read am say:
    (1) Some Senators de carry-go home lunch money #114,000 per day!
    (2) Broda Sege - Our former Mr President say na only God fit solve NEPA problem.
    (3) Prayer day for jobseekers by Naijahotjobs!



    (1) - Senators - # 114,000 x 5 (per week) = # 570,000 x 4 (per month) =
    # 2,280,000. That is two million two hundred and eighty thousand naira a month for lunch alone O! na dis one kon make me understand what dey mean when they say dem de take 'Ghana Must Go' carry money go home every week! My new name for this bag na 'NIGERIANS MUST WAKEUP' I then ask myself is it possible that none of these RAGAMUFFINS wey dey collect this kind money get unemployed people/graduates for his or her constituency to use half of the # 2.3 million monthly lunch money to open 'SOUP KITCHEN' and cook for people wey no get anything to go and chop!! My broda e no go happen he or she no go there to serve you but himself/herself!!! When you get the chance ask your REP abi SENATOR say na how many bill he or she sponsored, abi na how many statements he or she made for the plight of millions of Nigerians in his/her constituency with No light, water, good road or health-care or even food for table!

    (2) Broda Sege and NEPA - I read am say Mr former President, having spent Trillion something when he was in power, now don come back and say na only GOD fit solve NEPA problem. WHAT!!! Mr Obasanjo go be in is 70s or whatever his age, has anybody asked him that in all his years on the surface of this Earth whether he has seen, read, or heard anywhere in the World where GOD has come down to solve any economic, socio or political problem of any Nation - Noooo!!!! Na people like himself wey God put for position to rule a Nation go solve these problems or put the relevant and adequate plan or foundation in place. Has anybody seen gas-powered abi na coal-powered or Nuclear-powered station being built in Nigeria to aleviate the power supply problem? Make we all they wait O! and intestify our prayers and fastings one day God go just send Angels in answer to our prayers and fastings to build our power-stations for un-interrupted electric, roads for pot-hole free roads and hospital for health-care!!!!!!!!!

    (3) Prayer day for jobseekers - I believe in the power of prayer but not the type we are offering for Naija wey we wan take '419 God.' FOR SURE and CERTAINTY no one can fool the Allmighty.
    For example, I read on another job website the following job application from a graduate (now, these are not the exact words)
    Dear sir,
    I am Chaka-Chaka by name, 26 years old, 5' 6" in height and light in complexion. I am from okokobiri local government area of ijualuchukuw state.
    I am a graduate of Mechanical Engineering from Obialungozi University. If you think you have a vacancy suitable for me please give me a call on this number 0803-876-0009.

    I first saw the above on an employer vacancy page requesting for expression of interest for 'Web-designers'. then I thought this moron is a clown just making a joke to make people laugh not until I saw the same on other adverts. OK! If the above person pray and fast non-stop for '419' days he or she no go get job. The case is like somebody wey hear say dem de catch fish he kon pray then cary spear dey go throw am inside river with the hope of catching a fish. Abi someone wey know say palm-wine dey come from palm-tree, he kon pray and fast he kon go for the bottom of a palm-tree look up and open his mouth and say 'I command you in the name of...., palm wine faaaall'

    OK!!! Oga writer na wetin be your message now! Abeg make you wait small me I wan branch (digress) go something else.

    I read on another post about NERC bosses on investigation about some N5 biliion fraud, I kon shout as me a sabi, Yoruba go shout Y-eeee-pa!, Hausa go shout K-aaaaa-i! Nigerian Intentional Theif-Theif don graduate from stealing Millions to Billions the next group go kon up the ante to Trillions. Dat time when IBB dey rule us no bi say the guy dey pay our oil revnue into his personal account? If Nigeria oil income na 12 billion Dollars dem go pay all inside IBB personal account the guy go kon feel sorry for Nigeria as a country kon dash us like 1 billion dollars for our national budget! Dat time people shout, write and make noise, today you hear make anybody talk about the issue again!

    For all the people wey dey ask me wetin be the import of wetin a dey expound!

    I dey say the kind of CHANGE wey we need for this country of ours e no go HAPPEN by only fasting and praying O! or when people just sit-down dey say e go beta one day. Me a put the average age of today's graduates at around 25 years old. If we put their parents say for dat kind 50 to 60 years of age bracket. Make we ask these people of 50 abi 60 years old the condition of Nigeria as per NEPA, ROAD, HEALTH-CARE and THEIF-THIEF dem go tell us say na the same story since dey were born O! Politicians come Politicians go. Today's Politician see say nobody ask yesterday's Politicans wey steal Miliions dem kon graduate there own theif-thief to Biliions. REVOLUTION not only from 'Association of Unemployed Nigeria Graduate O! but from 'Association of Deprived Nigerians'. GOD BLESS NIGERIA.

  2. #2
    Senior Member gentlecheta's Avatar
    Join Date
    Aug 2008
    Posts
    158

    Re: Jobseekers and N.I.T.T

    Guy u get talent o..everytin fo pigdin and u no misyarn..i like u,u be correct
    Make use of what God gave you

+ Reply

Similar Topics

  1. Replies: 0
    Last Post: Mar 12th, 12, 04:25 pm
  2. VACANCIES FOR SERIOUS JOBSEEKERS
    By AIPFM in forum Admin, Banking and Finance
    Replies: 0
    Last Post: Jan 4th, 11, 02:05 pm
  3. ICT TRAINING FOR JOBSEEKERS, STUDENTS AND WORKERS
    By Bigvilla in forum Self Development and Training
    Replies: 4
    Last Post: Aug 19th, 10, 09:23 pm
  4. Jobseekers beware of this agency
    By emeystanley in forum Open Discussions
    Replies: 6
    Last Post: Nov 20th, 08, 06:01 pm
  5. Replies: 0
    Last Post: May 10th, 08, 12:36 pm

Posting Permissions

  • You may not post new threads
  • You may not post replies
  • You may not post attachments
  • You may not edit your posts
  •