Dat time wey ‘Pastor’ Okoromaduekwu start him ‘church’ for dat rented shop for Ajegunle una bi 6 members O!: Pastor + Wife + 2 kids + Pastor’s brother (wey bi your friend) + You = 6 members!

Abeg make I digress small O!

Okoromaduekwu na very talented guitarist, him kon join one band wey somebody don form for ground – wey dey sing dat kind song ‘as you see me sooo…’ dat time nobody dey invite dem for party and no record deals. Okoro quick-quick join anoda band (Yoruba) wey dey do plenty ‘praise-singing’ for parties and dey get plenty money. Make I cut long story for here short, na him Yoruba owner of the band kon sack Okoro say bicos him no fit they share money equally with band members as per say na him get the business O!

Okoro don make small money wey him too go take start him own business too. His guitar + speakers, small ‘alupupu’ generator (for when NEPA do dem show), one year rent on a small shop for Ajegunle. Okoro was also blessed with dat kind small ‘ORATORY’ capability and him sabi small passages for inside Bible – particularly him don cram the chapters and verses for Bible wey say make people contribute 10% of whatever!!!!

Every Sunday Okoro go woo people to church with guitar and songs sotay people kon boku for him church. Even muslims wey dey too lazy to wash and go touch head for ground for God for moshalashi full there self!

Okoro go preach-preach and tell him congregation how the 10% wey dem talk inside the Bible for contibute na your ‘visa’ to Paradise O! If you no contribute you dey buy ‘ticket’ to hell-fire. Him kon perfect this art of ‘cajole’ and ‘instil-fear’ sotay people wey him papa and mama no get money for chop for village go carry-go give Okoro 10% of monthly salary. Meanwhile Okoro still dey for the face-me-I-face-you one room for Ajegunle O! Until when him dom make sure him gather enof money to go buy one big place along Mile 2- Oshodi Express Road.

Small-small Okoro begin dey drive Hummer Jeep, dey wear suits from Saville Row tailors (London), silk-tie, crocodile belt and shoes (from Italy). Him don relocate to Aja and you? You still dey for the same face-me-I-face-you for Ajegunle!

Wetin me adey talk for here bi say ‘if you dey follow-follow make u open eyes, open brain open sense’! Dem don turn Church into big business for Naija (every where self) and muslims too don dey follow dem now!!!

You wey dey contribute 10% u still dey for your 2 x 2, pastor wey dey collect dey use HUMMER 4 X 4, him dey shine for body with puffed cheeks and you wey dey contribute your cheeks don enter sotay people fit count the number of teeth for your mouth even if you no open am – WAKE UP!!!!!

“Get Value for your Money”
Do you know the 10% you dey carry go church, go give you plenty reward from God if first you feed your parents and close relatives, kon dash the rest to beggars on the street instead to go dash to some 419ers wey dey take your money dey miliki?

NA FOR WHICH DAY WE GO WAKE-UP FOR THIS COUNTRY SELF!!!!!